Ministry of Enjoyment

0
Also Read

My Oga at the top
Na una I come greet
I salute una well well oh
For all the tins whey u dey do

For all our money whey una dey carry go Ghana
You carry dem put for suck-away
With the Ghana-must-go,
But one day Ghana go go

Una wicked small oh
Na sote heads dey roll for floor
But una no look our side
Na only your belly una know

Our pikins no see food chop
But na chicken your dogs dey munch
Our own pikins dey sit for floor in school
Ur pikins dey carry flight go school.

© Abiola Justice David

Post a Comment

0Comments

Leave a comment behind

Post a Comment (0)

#buttons=(Ok, Go it!) #days=(20)

Our website uses cookies to enhance your experience. Learn more
Ok, Go it!