Ministry of Enjoyment (Part 2)

0
Also Read


My Oga at the top
Na una I come greet
I salute una well well
For all the tins whey u dey do

Na sote money no dey, you dey shout
Crude oil e don pàfúká
Cocoa, cola, kolanut, e don finish
Where una carry dem go?

You carry them build your ministry of enjoyment
For una self and family?
But na sote ministry of endurance
You dey build for us and our unborn pikins

Na sote head plenty for mògún
But the ones whey no get offence
Na hin plenty pass
Wetin we take do you?

© Abiola Justice David

Post a Comment

0Comments

Leave a comment behind

Post a Comment (0)

#buttons=(Ok, Go it!) #days=(20)

Our website uses cookies to enhance your experience. Learn more
Ok, Go it!