Ministry of Enjoyment (Part 6)

0
Also Read

We sef wan sleep inside glass house
If we no fit sleep, we go break the glass
Make all of us kuku dey sleep under bridge
As you get head, na hin we get too

Na all of our children insurgency carry go
All our potential dey create bomb
Hunger fill the land sóté we don be pàdí
Corruption bòkú  for land, sóté we be example for others

Na we get crude oil pass
But we still be the largest importer
Na we get bitumen pass but
Ojúkòkòrò still wan kill us

Me don taya oh, abi una no taya ni?
As we dey do things don taya mi na
But e don tei whey we don dey talk am
No be today, my brothers and sisters.

© Abiola Justice David

Post a Comment

0Comments

Leave a comment behind

Post a Comment (0)

#buttons=(Ok, Go it!) #days=(20)

Our website uses cookies to enhance your experience. Learn more
Ok, Go it!