Ministry of Enjoyment (Part 4)

0
Also Read

My Oga at the top
Na una I come greet
I salute una well well
For all the tins whey u dey do

Na to dey shout, we dey on top the situeisan
All the time sote
Dem wan kill all of us finish like chickens
I don tire down now sef

Darkness come become our friend
Sotee, hin bright pass sunlight
Hunger for morning, depression for noon
Death for night; three-square meal

Na sote hardship you dey bring
With your sweet mouth
Increment and inflation
Na hin be your blueprint.

© Abiola Justice David

Post a Comment

0Comments

Leave a comment behind

Post a Comment (0)

#buttons=(Ok, Go it!) #days=(20)

Our website uses cookies to enhance your experience. Learn more
Ok, Go it!